Monday, February 6, 2017

ENIGMA - 12

SCENE 14
EXT. KC SHOP/OUTSIDE - MORNING
KC is seen working in his shop. Shortly, Edwin arrives with rucksack. His head still bandaged.

EDWIN
Oga KC.
KC
Edwin how you dey nah?
EDWIN
How you come take know my name?
KC
You wey your Mama dey call your name throughout last night when you no gree wake up. Your Mama fear sha.
EDWIN
I say make I come thank you for last night. My Mama tell me how you take save me.
KC
Oh boy, make you go dey thank your God o. By now you for don turn bolle. You know bolle?
EDWIN
Plantain wey them roast?
KC
Exactly. You for don roast, dry finish by now.
EDWIN
Chai! People wicked o. So after them nack me stick for head, them still plan to roast me?
KC
Na hin make kurukere movement no good for night.
EDWIN
So na only morning and afternoon person go dey waka now?
KC
That's Naija for you.
He notices rucksack behind Edwin.
KC(CONT'D)
You dey travel?
EDWIN
No, na you I come see.
He takes out briefcase from rucksack.
EDWIN(CONT'D)
Na this my briefcase no gree open. I lost the key and I don try tire I no fit open am. You go fit help me use any of your tools open am?
KC
Make I see am.
Hands briefcase to KC.
KC(CONT'D)
Na wetin dey inside?
EDWIN
Na hin I dey talk nah, say the thing no gree open.
KC
I be wan know wetin dey inside make I know how I go take open am.
EDWIN
You fit open am anyhow. No worry.
KC looks around his tools. He places briefcase in clamp and begins to saw. Edwin looks around and picks a thick bar.
KC
I hope you no dey use the briefcase again because e go spoil when I open am.
EDWIN
No problem. This rod, na like how much them dey sell am?
KC
That size na two five for length.
He continues to saw and finally briefcase gives way. Edwin is armed ready but oblivious to KC. KC opens briefcase wide, they both look inside and find a camcorder.
KC
Na camera you keep inside briefcase?
EDWIN
Er...yes.
KC picks camcorder and looks at it closely.
KC
Hmm...na which one come be all this papers?
Edwin takes camcorder from him, places it in briefcase, and puts everything in rucksack.
EDWIN
Thank you, oga KC. Make I come dey go. I go see you later.
KC
Make you no dey waka for night again o!
EDWIN
I hear you!


Movie Scripts

From here you can find nearly all Hollywood movie scripts of your favorite movies available to read on the internet, free. Note: Some scrip...